You are here: HomeAfricaBBC2023 12 16Article 1899785

BBC Pidgin of Saturday, 16 December 2023

Source: BBC

Baby hang alive for tree afta Tennessee tornado

Dem find di four month old baby safe Dem find di four month old baby safe "by di grace of God" afta tornado take am from im house

Parents of one four month old baby say dem find dia pikin alive "by di grace of God" afta one tornado for Tennessee suck di child, carry am waka.

Di husband and wife say di deadly tornado wey occur on Saturday tear dia mobile house to piece, pick up one baby bed wit dia pikin still inside.

Im survive and dem find am inside one tree wey fall inside di heavy rain.

Di baby, im one year old brother and parents only suffer from minor cuts and scratch.

As di turnado dey come, di mama of two, 22 years old Sydney Moore, say e tear di roof of dia mobile house comot.

"Di tip of di tornado came down and pick up di baby bed wit my pikin, Lord, inside," Madam Moore tell one local news station. "Im bin be di first tin to go up."

Her boyfriend - and di boy papa – jump forward to protect Lord wey dey di baby bed, but di tornado pick am up too.

"Im bin just hold di bed di whole time, and dem enta di circles, im say, den di tornado thruway dem," Madam Moore say.

As dat one dey happun, Madam Moore grab her one year old son, Princeton.

"Sometin insid me just tell me to run and jump on top of my son," she say. "In fact as I just jump on am, di walls collapse."

"E really crush me, I bin no fit breathe," Moore remember.

After di tornado pass, na im she bin fit escape di crush from di walls wey fall on top her and Princeton.

She and her boyfriend immediately start to look for Lord.

Afta dem look for dia pikin inside di rain wey dey pour, dem find di pikin - alive – for wetin Madam Moore say "e look like one small tree cradle".

"I bin tink say im don die," Moore say. "I bin dey very sure say im don die and we no go fit find am."

"But im dey here, and dat na by di grace of God."

Madam Moore sister, Caitlyn Moore, bin don start one GoFundMe to help dem afta di tornado completely destroy dia car and house.

Di children and Madam Moore escape wit only minor cuts and bruises, but her boyfriend break one arm and shoulder, Caitlyn Moore say.

According to di GoFundMe, Lord "bin look like dem place am on di tree gently" - as if "one angel guide am safely to dat spot".

"I go die for my kids. Dat no even be question. And my boyfriend go do di same tin," Moore tok.