You are here: HomeAfricaBBC2023 12 08Article 1895237

BBC Pidgin of Friday, 8 December 2023

Source: BBC

BBC confam video show Palestinian men witout clothes for detention for Gaza

Israeli soldiers parade Palestinian hostages Israeli soldiers parade Palestinian hostages

Wit di fighting wey dey serious around Khan Younis and for north of Gaza, one video show face on social media wey show dozens of Palestinian men wey Israel detain.

Di video footage, wey BBC verify, show as dem wear only underwear, kneel down for ground and Israeli soldiers guard dem.

E be like dem arrest di men for Beit Lahia, wey dey di far north of Gaza strip.

Wen dem ask about di video, one tok-tok pesin for di Israeli goment tell di BBC say all di detained men don reach military age and dem bin "discover dem for areas wey civilians don suppose to comot from weeks ago".

For di video, dozens of men line up for pavement, and e appear to be like say dem tell dem to remove dia shoes, wey scatter across di road. Israeli soldiers and armoured vehicles stand dey guard dem.

Oda images show as dem dey transport dem inside military trucks. For di Israeli media, dem describe di captives as Hamas fighters wey don surrender.

Anoda image - wey BBC neva verify - show men wey dem blindfold, dem kneel down for wetin appear to be a large pit of bulldozed sand.

Di Israel Defence Forces (IDF) neva comment directly on di images, but tok-tok pesin Daniel Hagari tok on Thursday say di "IDF fighters and Shin Bet officers bin detain and interrogate hundreds of terror suspects".

"Many of dem also turn diasef to our forces during di past 24 hours. We dey use di intelligence wey dey come out of dia interrogations to continue di fighting."

On Friday, Israeli goment tok-tok pesin Eylon Levy tell di BBC say dem bin detain di men for Jabalia and Shejaiya wey dey northern Gaza, wey im describe as "Hamas strongholds and centres of gravity".

"We dey tok about military age men wey we discover for areas wey civilians suppose to don comot from weeks ago," im tok.

Oga Levy add say dem go question dem to "work out who be tru-true Hamas terrorist and who no be terrorist".

Im emphasise say dem find di detained men for areas wia Israeli forces bin engage in "close-quarter combat" wit Hamas. Dem bin dey "deliberately disguise demsefs as civilians" and operating from civilian buildings.

However, different accounts dey emerge from pipo wey dey on ground. Ethar Shalaby of BBC Arabic follow one man tok wey say 10 of im cousins dey part of di group wey di Israeli army detain on Thursday for Beit Lahia.

Im dey very concerned for im and im family safety, and im wish to hide im identity. Di man dey live for di Middle East.

Im say im receive one phone call from two of im cousins at around 14:00 Gaza time.

Dem tell am say di IDF bin detain 10 of im cousins. Im two cousins tell am say IDF sojas enta di area and use microphones to order di men from dia homes and UN relief agency (UNRWA) schools.

Im cousins tell am say di IDF order di women to go to Kamal Edwan Hospital. Di IDF kon threaten to shoot di women if di men no come out.

Di man say dem don release seven of im cousins since and dem don come back house.

Im no know about di fate of im three cousins wey remain for di Israeli detention.

Dem don identify one well-known Palestinian journalist, Diaa al-Kahlout, wey be correspondent for al-Araby al-Jadeed, as one of di pipo wey dem hold captive.

Di Arabic language news outlet, wey dey also publish in English under di name di New Arab, say dem bin arrest Mr al-Kahlout wit im brodas, relatives and "oda civilians" by Israeli forces in Beit Lahia.

Al-Araby al-Jadeed don condemn wetin im describe as di "humiliating" detention of Mr al-Kahlout on Thursday.

Im add say sojas force di men to remove dia clothes and "subject dem to by-force searches and humiliating treatment wen dem arrest dem, dis na before dem transport dem to locations wey dem no sabi".

Di outlet "dey beg di international community, journalists rights defenders and watchdogs, and human rights bodies to denounce dis ongoing assault" wey Israel dey do on journalists wey dey di territory.

Di BBC don ask di IDF about Mr al-Kahlout detention wey dem report.