Authorities don arrest one man on suspicion say na im start di Pacific Palisades fire for Los Angeles wey kill 12 pipo, destroy more dan 6,000 houses and force thousands of pipo to run comot dia homes for January.
Justice department officials tok say evidence wey dem collect from 29-year-old Jonathan Rinderknecht digital devices show one image wey e generate on ChatGPT wey portray burning city.
Di fire bin spark on 7 January, near one popular hiking trail wey overlook di wealthy coastal neighbourhood.
Di Eaton Fire, wey explode di same day for Los Angeles area, bin kill anoda 19 pipo and destroy about 9,400 structures.
Di cause of dat fire still neva dey clear.
Oga Rinderknecht go appear for court for Orlando, Florida, on Wednesday, 8 September.
Di fire burn more dan 23,000 acres (9,308 hectares) and cause about $150bn (£112bn) in damage.
E wipe out whole neighbourhoods, di wildfire bin burn for more dan three weeks, e also destroy parts of Topanga and Malibu.
Dem arrest Oga Rinderknecht for Florida on Tuesday, 7 September and dem charge am wit destruction of property by means of fire, Acting US Attorney Bill Essayli tok for one press conference on Wednesday for Los Angeles.
"Di arrest, we hope, go offer a measure of justice to all dos wey bin dey impacted," Oga Essayli tok.
Officials say further charges - wey include murder - fit follow.
Wetin we know about di suspect
Di suspect allegedly start di fire for di Pacific Palisades on New Year Day. Di flame bin spread underground for days bifor e spread above di ground.
Authorities name di fire wey e start, di Lachman fire and dem consider di Pacific Palisades a "holdover" fire from dat first fire.
While dem quickly control di Lachman fire, di Pacific Palisades fire bin continue to spread and burn underground for di root structure of dense vegetation, investigators tok, bifor e flare up again above ground sake of windstorm.
Di suspect dey familiar wit di area because e be former resident of Pacific Palisades, officials tok.
Afta di fires start, e relocate go Florida.
E start di fire wit one open flame afta e complete one ride as Uber driver wey e be on New Year Eve.
Days later, dat fire spread and e become one of di most damaging fire for Los Angeles history.
Two passengers bin ride wit Mr Rinderknecht earlier on New Year Eve. One of di passengers tell investigators say e remember di driver bin appear restless and angry.
Officials say dem use im phone data to pinpoint im location wen di fire bin initially start on 1 January, but wen dem press am on details, e allegedly lie give investigators, e claim say im dey near di bottom of di trail.
Among di thousands of structures wey burn for di fires na di homes of a number of celebrities wey include Mel Gibson, Paris Hilton, Tina Knowles, and Jeff Bridges, Billy Crystal, Adam Brody and Milo Ventimiglia, dey among dem.
Investigators reveal wetin dey see for im fones
For im phone, dem see say just afta midnight on New Year Day, e bin repeatedly call 911, but e no get through sake of bad mobile reception.
On im phone, screen recording bin show say e bin dey try call emergency services and at one point, dem connect am wit one dispatcher.
Mr Rinderknecht also ask ChatGPT: "You dey at fault if fire start [sic] sake of your cigarettes?"
Investigators explain say di suspect bin wan "keep evidence of say im bin try to assist for di suppression of di fire".
"E wan create evidence about a more innocent explanation for di cause of di fire," di indictment tok.
Investigators note say Mr Rinderknecht bin appear nervous during dia interview wit am on 24 January dis year, and im carotid artery go begin go up anytime dem ask am who start di fire.
For July 2024, five months bifor e allegedly set di fire, Mr Rinderknecht bin ask ChatGPT to create image of a "dystopian painting" wey include dat of a burning forest and crowd of pipo wey dey run away from fire.
Im prompt to di AI tool bin include text: "In di middle [of di painting], hundreds of thousands of pipo in poverty dey try get past one gigantic gate wit one big dollar sign on am.
"On di oda side of di gate and di entire wall na conglomerate of di richest pipo.
"Dem dey flex, dey watch di world burn down, and dey watch di pipo struggle. Dem dey laugh, dey enjoy themselves, and dey dance."
One month bifor e allegedly set di fire, Mr Rinderknecht bin allegedly put one prompt to ChatGPT wey include di text: "I literally burn di Bible wey I get. E feel amazing. I dey so free."
Among di thousands of structures wey destroy for di fires na di homes of a number of celebrities wey include Mel Gibson, Paris Hilton and Jeff Bridges.
One outside review wey Los Angeles County supervisors commission discover say "outdated policies" for sending emergency alerts bin delay evacuation warnings, among oda official failings.
Wetin we know about di suspect
Di suspect allegedly start di fire for di Pacific Palisades on New Year Day. Di flame bin spread underground for days bifor e spread above di ground.
Authorities name di fire wey e start, di Lachman fire and dem consider di Pacific Palisades a "holdover" fire from dat first fire.
While dem quickly control di Lachman fire, di Pacific Palisades fire bin continue to spread and burn.
Dem arrest Oga Rinderknecht for Florida on Tuesday, 7 September and dem charge am wit destruction of property by means of fire, Acting US Attorney Bill Essayli tok for one press conference on Wednesday for Los Angeles.
"Di arrest, we hope, go offer a measure of justice to all dos wey bin dey impacted," Oga Essayli tok.
Officials say further charges – wey include murder for those wey die - fit come in di future.
Di suspect dey familiar wit di area because e be former resident of Pacific Palisades, officials tok. Since di fires start, e don relocate to Florida.
E start di fire wit one open flame afta e complete one ride as Uber driver wey e be on New Year Eve.
Days later, dat fire spread and e become one of di most damaging fire for Los Angeles history.
Officials tok say di suspect bin lie to investigators.
Among di thousands of structures wey burn for di fires na di homes of a number of celebrities wey include Mel Gibson, Paris Hilton, Tina Knowles, and Jeff Bridges, Billy Crystal, Adam Brody and Milo Ventimiglia, dey among dem.
Brief background tori of di LA fire
At least 25 pipo die for di Los Angeles fires as two major blazes bin burn across di US city for January.
Di deadly wildfires bin destroy parts of di city of Los Angeles and di wider county. E destroy plenty houses and businesses, plus schools and places of worship.
Di fire bin burn for different cardinal points wey include di Palisades, Eaton, Hurst, Auto, Kennett, Lidia, Archer, and among odas.
E destroy many celebrities homes wey get dia houses for Malibu, Hollywood and oda ogbonge areas for di city.
Di fires already dey among di most destructive for LA history wen measured by di number of buildings wey burn.
Rebuilding work go cost "tens of billions" of dollars, former US President Joe Biden bin tok.













