You are here: HomeAfricaBBC2023 09 30Article 1853948

BBC Pidgin of Saturday, 30 September 2023

Source: BBC

Authorities arrest man in connection to Tupac Shakur murder for 1996 - Reports

Tupac Shakur Tupac Shakur

Police for Las Vegas don reportedly arrest one man wey get hand for di murder of rapper Tupac Shakur nearly three decades ago.

Dem bin shoot di hip-hop legend fours times for one drive by-shooting inside Las Vegas for 1996.

On Friday morning, Las Vegas police arrest one man over im death, according to sources wey tok to AP news agency.

Shakur, wey be one of hip-hop most acclaimed rappers bin dey only 25 years wen im die.

Dem neva still know who kill am.

Im die on 13 September 1996, a week afta dem shoot am four times inside im car wen im dey wait for red light.

Di death of di rapper, one of di ogbone hip-hop pesin, don inspire several documentaries.

Shakur bin sell more dan 75 million records worldwide, im bin dey enjoy chart success wit hits including California Love, All Eyez On Me and Changes.

We dey update dis tori.