You are here: HomeAfricaBBC2023 12 08Article 1895285

BBC Pidgin of Friday, 8 December 2023

Source: BBC

Asides UK, oda kontris wia health workers fit migrate to wit dia family

File foto of health workers File foto of health workers

UK goment don reveal one package of measures to reduce di number of pipo wey dey migrate to di UK.

Home Secretary James Cleverly say di changes wey dey due to take effect from next spring go bring about di biggest ever cut in net migration.

E dey happun afta di net migration - di difference between di number of pipo wey dey go live for di UK and those wey dey comot reach a record of 745,000 last year.

Key points from di changes to UK visa include a ban on health and care workers from bringing family dependants to UK and to end companies being able to pay workers 20% less dan di going rate for jobs on a shortage occupation list.

Odas na to raise di minimum income for family visas to £38,700 from £26,200, from next spring and ask di goment migration adviser to review di graduate visa route to "prevent abuse".

Di new changes don cause reactions and pipo wey dey reason to migrate dey check out oda alternatives and oda kontris wey dey issue visa give professional health workers wey wan work, earn money and carry dia family travel.

Kontri wey health workers fit carry dia family enta on work visa

Australia

Di Australia goment dey offer health workers and dia family different visa options for short-term, long-term, and permanent residence. Di kontri demand for skilled health dey high for dia public sector.

Di visa dey available for anybody wey dey under di age of 45 years old and im skill dey relevant for dia kontri. Di visa application dey encourage applicants make dem come dia kontri come settle down wit dia family for five years

If you wan apply for your family member as second applicant afta you don get your sponsorship work visa, you go need to prove say your family members get enough money to care for dia welfare for Australia.

Also, you go need prove say you sabi English, get valid passport, no get outstanding debts, no prior refusal and no be ex-convict.

Finland

Foreign health workers fit work for Finland afta dem don already get dia employers sponsorship application. Immigrants from Nigeria go need dia airport transit visa before dem go fit enta di kontri.

Dem go need to begin work for di kontri as health care provider so dem go qualify for di kontri permanant resident visa before dem go fit bring dia spouse or pikin under di age of 18 years old into di kontri as dependants.

Canada

Canada Health sector dey important to di Canadian goment, dem don invite 500 skilled health workers make dem apply come join di kontri public health sector.

For 28 June, 2023, Sean Fraser, Canada immigration minister announce say dem go invite 500 health workers wey go dey work for dia kontri.

Di categories na speech language, pathologists, chiropractors, dentists, dieticians, nutritionists, education counsellors, general practitioners, family physicians, kinesiologists, massage therapists, nurse medical laboratory assistants and oda technical health care service providers.

Canada dey among di kontris wey dey offer immigration-friendly policy for immigrants as dem still get open job applications for dependants wey dem fit dey work.

Foreigners fit migrate into di kontri wit dia families to go join di 2,000 workforce wey Canada goment need.

Sweden

As foreign health workers for Sweden you need get di Swedish medical license before you go fit practise legally for Sweden. Before you travel go Sweden make sure say you don get employment as health worker. Doctors or nurses fit negotiate dia salary before dem travel comot from dia kontri.

Afta dat, you fit carry your family members as dependant sake of say dem dey live under your roof and dem no need social-assistance. Pikin wey dey under 21 years old too dey qualified as dependants but you go need show prove say you or your partner fit provide for dem financially.

Germany

Germany dey among di kontris wey you go need apply for work visa as individual but you no fit carry your family until you apply for family reunion visa. So, you go dey financially responsible for di relatives.

Di dependant go need to speak German or basic German, get invitation letter, visa and birth certificate (for pikin under 18).