BBC Pidgin of Friday, 19 December 2025
Source: BBC
Evritin don set for di ogbonge fight betwin Nigerian-British former boxing heavyweight champion, Anthony Joshua and social media sensation-turned boxer Jake Paul.
Dis fight don cause plenty tok-tok since dem announce am in November, as some boxing sabi pipo say na one-sided match e go be sake of say Joshua don be world champion several times while Jake Paul since e start professional boxing neva even fight any serious contender.
Odas say Joshua agree to di fight just for di money wey go dey involved, but di two-time heavyweight champion say even though money folo for why e agree to di fight, e dey also do am for legacy sake.
Jake Paul bin don claim for social media say di money wey dey involved for di fight go reach about $267m.
Both men don dey blow hot about dis match, and Joshua bin tok say e no go mercy for Paul as e tell am for one pre-match event say "if I fit kill you (for inside di ring), I go kill you".
On Thursday, during dia weigh-in event, Joshua tok say: "I go just outclass dis kid. I be serious fighter. Dat na di difference. I be serious, serious fighter."
Paul for im side bin don tell tori pipo say: "I dey ready. I want im hardest punches. I no wan make any excuses dey afta evritin don pass. Make we kill each oda."
Also afta di weigh-in on Thursday, Paul say im bin see fear for Joshua eyes.
"Di pressure dey on am. I dey fight free. I don already win. Dis na lose-lose situation for am. I don get am right wia I want am."
Dis no be di first time Anthony Joshua go fight somebodi wey no too be im level for professional boxing.
For march 2024, Joshua bin face Francis Ngannou, who bin dey try im luck for pro-boxing afta e don dominate di world of heavyweight Mix-Martial Arts.
Di match end for second round knockout victory for Joshua.
Wia dis match go happun
Dis ogbonge fight go hold for di Kaseya Center for Miami, USA, wey im former name na di American Airlines Arena and also FTX Arena.
Di 19,500-capacity arena na di home of di ogbonge basketball team Miami Heats.
Even though di venue na majorly a basketball event centre, dem fit also reconfigure am for concerts, worship events, family events, musical shows and oda stage productions.
Dis venue don bring goodluck bifor for Nigerian mix-martial arts fighter Israel Adesanya in 2023.
Na for dia Adesanya bin win im ogbonge revenge match against Alex Pereira for di UFC Middleweight Championship, wia e knock am out for di second-round.
Major World Wrestling Entertainment (WWE) fights don also happen for di Kaseya centre, but dis Anthony Joshua vs Jake Paul battle na di biggest event wey go happun dia so far.
