Eleven pipo wey dem detain for Ghana after dem deport dem from US don sue di West African nation govment, dia lawyer don tell BBC.
Oliver-Barker Vormawor say di deportees bin no violate any Ghanaian law, and dia detention inside military camp therefore dey illegal.
E want govment to produce di group for court, and justify why dem dey hold dem against dia will, di lawyer add.
Di govment never comment yet on di law suit, but dem bin don tok say dem plan to accept anoda 40 deportees. Opposition MPs dey demand di immediate suspension of di deportation deal until parliament ratify am, as dem say na requirement under Ghanaian law.
Last week, Ghana President John Mahama say 14 deportees of West African origin bin land di kontri following one agreement dem reach wit US.
E later say dem don return all of dem to dia kontris of origin, though Foreign Minister Samuel Okudzeto Ablakwa contradict am by saying na only most of dem don dey returned.
Mr Vormawor court application contradict both of dem, say 11 deportees still dey detention inside Ghana.
Dem bin hold di 11 for one US detention facility before dem chain and deport dem inside military cargo aircraft, according to papers dem file for court.
Di deportations na part of di US govment hard-line approach towards immigration since President Donald Trump take office in January.
E don vow to conduct record-level deportations of migrants for di kontri illegally.
Reuters quote Ghana foreign minister on Monday say di decision to accept di deportees dey based on "humanitarian principle and pan-African empathy".
"Make e no dey mistaken as endorsement of di immigration policies of di Trump administration," e tok.
Five of di detainees, three Nigerians and two Gambians, don also sue US govment, as dem argue say dem bin dey protected by one court order and dem no suppose deport dem.

President John Mahama don face criticism from opposition MPs for failing to present di deportation deal in parliament for ratification











