Trades union congress (TUC) of Ghana togeda wit civil society groups, faith leaders, women and citizens dey hit di streets of Accra to call for debt cancellation and trade justice.
Di groups say "African kontris don dey suffer from huge debts and exploitative trade systems wey don deny Africa di wealth it suppose get from di plenty resources dem get."
According to di groups, "Africa's sovereign debt bin reach $2.14tn as of 2024 wia 22 African kontris dey high risk of distress."
"Today seven African kontris dey spend more to service di interest on dia debts, than dem dey spend on education, wey 25 bin spend more on debt interest than wetin dem dey spend on health."
Di international trade union confederation (ITUC) now don declare say di bleeding of Africa gatz to stop sake of "Africa bin dey receive loans, aid and remittance of $162b wey dem dey lose $203b thru illicit financial flows and profit wey companies bin dey carry out of di continent. Dis mean say Africa dey lose $41b every year."
For dis demonstration, dem dey wan send clear message say Africa neva go continue to accept dis system of modern neo-colonial exploitation.
Protesters bin dey carry placards and banners wit messages like "Cancel Africa's Debt Now!", "Debt Cancellation na Reparation!", "People-Centred AfCFTA!", and "Stop the Bleeding! "among odas.
Dem also go do wetin dem describe as 'chain-breaking' ceremony to show say Africa dey fight for her freedom from di shackles of debt.
Di campaigners say dem bin write to lenders and donors thru dia agents and embassies to join di protest for global financial institutions to listen to dia demand for justice.
Inside one statement, dem tok say "civil society groups, trade unions for di continent and oda movments go deliver petition to policymakers to demand debt cancellation, trade justice and reforms for di global financial system."
Ogbonge journalist and activist oga Kwesi Pratt Jnr wey bin dey talk always about reparation dey quoted by state newspaper Daily Graphic say "no amount of moni fit compensate for di crimes wey dem commit against Africa by di capitalist states."
"Wetin we want, na di complete reset of di world and di institutions to ensure equality of all pipo and to build new world wia all forms of poverty and exploitation don dey banished forever."











