Di Final Draw for di TotalEnergies Africa Cup of Nations (Afcon) go happun on Monday 27 January, 2025 for di iconic Mohammed V National Theatre for Rabat.
Di draws go determine which kontri go face each oda for di group stage.
Di 24 teams (kontris) wey qualify for di biggest football tournament for Africa dey grouped into different pots. Na from dis pots dem go begin pick and put dem for groups.
Morocco go host di 2025 Afcon for di first time since 1988. Di tournament go start from 21 December 2025 to 18 January 2026.
Caf bin also unveil a new logo, wey dem describe as a modern and iconic symbol for African football, wey dey celebrate di heritage and unity of di African continent.
Dem aslo tok say e dey tell a story of pride, resilience and hope wey dey inspired by Moroccan ''zellij'', one timeless mosaic art form, di tournament logo dey redefine football as a canvas wia creativity, precision and passion dey jam.
Teams wey dey di tournament
See di 24 teams wey qualify for di tournament and dinpots wey dem dey ahead of di draws.
Pot 1: Morocco (hosts), Senegal, Egypt, Algeria, Nigeria, Côte d'Ivoire
Pot 2: Cameroon, Mali, Tunisia, South Africa, DR Congo, Burkina Faso
Pot 3: Gabon, Angola, Zambia, Uganda, Equatorial Guinea, Benin
Pot 4: Mozambique, Comoros, Tanzania, Sudan, Zimbabwe, Botswana
African legends Mustapha Hadji, Serge Aurier, Aliou Cisse and Joseph Yobo go be assistants for di Final Draw.
Hadji, Cisse, Aurier and Yobo no go only pull di balls from di pots, but dem go also give analysis into di groups for di tournament.
Cote d'Ivoire na di defending champions as dem host di 2023 edition wey happun for early 2024.











