BBC Pidgin of Tuesday, 3 January 2023
Source: BBC
Nollywood actor Yomi Gold wey dey popular for Yourba feem don announce separation from im second wife, Meenah.
Di actor wey im real name na Yomi Alore say dem decide to go dia separate ways as love don die for dia relationship.
Dia separation dey come barely one year afta dia marriage.
Yomi wey announce di end of dia marriage on im verified Instagram account say na di two of dem decision and e want make dia families understand.
E post say “Wen love die for relationship, make nobody force am.”
E add say im wife, Meenah na beta pesin and no deserve man like am.
“She go make a great and loving partner to a far beta pesin dan me.” E tok.
View this post on Instagram

