BBC Pidgin of Friday, 17 January 2025
Source: BBC
Report don show say about 50,000 international students wey apply for study permit for Canada to get higher education no show for di school wey dem apply to.
Di colleges and universities wey dem suppose enrol into report say di applicants no show up.
According to di goment data from spring 2024, di number of dose wey dey affected reach 50,000 from kontris like Nigeria, Rwanda, Ghana, Iran among odas.
However, na India and China be di kontris wey dey top di list of di kontris wey get di highest number of non-compliant student applicants wey no show up for di schools wey dey suppose enrol into.
Meanwhile, bifor now, Canadian goment bin announce new restrictions on work and study permit for international students wey wan undergo postgraduates studies as dem plan to reduce di number of dia annual students intake.
But dis 'no show' report don also raise plenti questions on if international students dey comply wit Canada study system.
In addition, anoda set of 23,514 students wey constitute 3.3% dey unreported and dis dey worry di Canada system.
Immigration, Refugees, and Citizenship Canada (IRCC) track 6.9% of all international students wey no show up afta dem apply for study permit.
Dis system of report bin dey introduced for 2014 through di International Student Compliance Regime for Canada wey require make education institutions dey report two times in a year.
Canada introduce di regime to know if international students dey actively enrolled and if dem dey attend classes for di school wey dem apply to.
Canadian universities and colleges bin submit di compliance reports to IRCC, wia dem find say tens of thousands of international students fail to obey di terms of di study permits for 2024,