You are here: HomeAfricaBBC2023 11 02Article 1873874

BBC Pidgin of Thursday, 2 November 2023

Source: BBC

14-year-old girl collabo with her classmates to allegedly kill lecturer - Police

Dr Funmilayo Adefelalu Dr Funmilayo Adefelalu

Police for Niger state inside north central Nigeria don announce di arrest of one 14-year-old girl for allegedly murdering Dr Funmilayo Adefelalu.

E happun on Saturday, October 28 2023.

Dr Funmilayo na lecturer for Federal University Minna and di girl bin dey work as her maid for three weeks before dem separate.

According to police, Dr Funmilayo bin dey inside house wen her former maid visit di house wia dem use stool to hit her for head and also use knife stab her several times.

“Wen we reach di scene of di crime, we meet di lifeless body of Dr Funmilayo and two knives with blood stains.

We carry di body to IBB Hospital for Minna wia doctors confam say she don die.” Dem tok.

DSP Wasiu Abiodun wey be tok tok pesin for Niger State Police Command add say na interviews with neighbours and friends lead to di arrest of di 14-year-old.

“Two of her classmates wey helep her (allegedly) to carry out di crime dey on di run at di moment but efforts dey go on to arrest dem.”

University mourn ‘dedicated’ lecturer

Di university say dem dey mourn di dedicated lecturer Dr Funmilayo wey be associate professor for di Department of Biochemistry.

Statement wey Mrs Lydia Legbo, Head of di Public Relations and Publications Department for FUTMinna release show say di late lecturer join di university as assistant lecturer for 2005.

She be originally from Shaki town inside Oyo state for southwest Nigeria.

“Di entire university dey sad and dey mourn dis vibrant and dedicated individual.

We dey pray to God to rest her soul and security authorities at dis time dey continue dia work.”

What next for di arrested 14-year-old?

Barrister Wada Wada na legal practitioner for Nigeria and aide to Nigeria President for Attorney General office. E tell BBC Pidgin say di underage girl go get trial for court as an adult.

“So wetin dey dia be say her trial go happun normal for High court despite her age but sentencing no go happun until she reach 18.

So afta di trial, dem go keep her for remand home, part of prison wey dem dey keep pipo wey neva reach 18. And on reaching 18 her sentencing go now take place.”

But in terms of di trial nothing go differentiate her with mature alleged offender.” E tok.