You are here: HomeAfricaBBC2023 09 19Article 1847261

BBC Pidgin of Tuesday, 19 September 2023

Source: BBC

12-year-old Debola wey im intestine bin miss for Lagos hospital don die

File photo File photo

Di 12 year-old boy simply identified as Debola Akin-Bright wey im intestine bin miss for hospital don die.

Close member of di family confam to BBC News Pidgin and add say di boy bin get internal bleeding.

Im say dem rush Debola to intensive care unit for di Lagos state university teaching hospital (Lasuth) - wia dem bin dey try save di situation.

Di family member say Debola Akin-Bright give up inside di ICU.

Di 12-year-old boy bin dey battle for survival afta dem perform multiple surgeries wia dem confam say im small intestine dey miss.

Dis na breaking tori. Refresh di page for more updates.