Di first open sale of tickets for di 2026 World Cup show say Fifa dey charge up to $10,990 (£8,333) to go watch di final.
Dis be like di most expensive general admission to watch football match.
For dia World Cup bid book, di US, Canada and Mexico say tickets to di final go cost maximum of $1,550 (£1,174).
By di time tickets go on sale to members of each kontri official supporters club in December, di most expensive dey listed at $8,680 (£6,581).
Prices den go up again wen dem begin di final sale period for Wednesday.
Tickets for di Qatar World Cup final cost about $1,604 (£1,214) for di expensive seat.
To establish di actual cost of tickets for dis summer tournament dey difficult as Fifa neva release dia pricing structures.
E dey also use version of dynamic pricing, whereby prices change for di start of each sales point depending on past demand.
Late last year, di cost of di initial ticket wey dem release dey described as a "monumental betrayal". For December, Fifa announce small number of $60 (£45) tickets.
On Wednesday tickets dey on open sale for di first time - and e show di amount wey dem dey charge.
Which prices dey observed for di final
E dey impossible to assess di overall ticket pricing wit no information on di prices, or di volume available for each category.
Going through di Fifa ticketing website and seeing wetin dey available and wetin dem dey charge dey give good indication. Howeva, dat no confam if e get more expensive tickets still, or if more dey available for more affordable categories.
From wetin we observe, ticket prices for di World Cup final increase by as much as 38% for di open sale compared to December release.
Apart from di $10,990 (£8,333) category one ticket:
.Category two dey up to 32.78% from $5,575 (£4,227) to $7,380 (£5,596)
.Category three increase to 38.23% from $4,185 (£3,173) to $5,785 (£4,386)
Fifa also give no advanced notice of which games go dey available on Wednesday, or dia price, as di "last-minute sales" period start.
Dos wey enta di site find say prices don go up for di most in-demand fixtures - including di top teams and oda key knockout games.
Wetin we learn wen we join di queue
BBC Sport join di queue for World Cup tickets alongside di supporters on Wednesday at about 15:20 BST.
One message dey in place, and by 16:00 dis change to red circle wit di message: "Almost there…"
By 17:00 countdown clock appear. We dey two minutes from di front wen di time suddenly jumped back up to 15 minutes.
Wen we gain access, we experience di same technical glitch as thousands of fans.
Supporters wey log in early dey wrongly directed into a queue for "PMA tickets", reserved for fans of dis week play-off winners.
Once you dey through, dem go send users to a page wia code dey required to open up sale for dose fixtures.
By di time di mistake dey realised, dose supporters dey forced to start again for di back of di correct virtual line. Any chance of securing a ticket for one of di more attractive matches don go.
Fifa no provide reason for di error but say dat by 17:00 di links dey work properly.
Once you come back to di queue e take six hours and 14 minutes to get access to di ticket page.
Of di 72 group games, 35 matches dey listed wit tickets available, but no allocation for di England or Scotland games, or any of di knockout matches, wen we initially enta.
Wit di exception of di host nations, only one match of di top-10 seeded kontris, di Netherlands, dey available to buy.
Prices range from $140 (£106) to $2,985 (£2,261). Di average price of dose wey dem display na $358 (£271).
Di most expensive group stage match wey we see na di first of di tournament between Mexico and South Africa for $2,985 (£2,261), wit only tiny proportion of di 87,000 capacity available.
Additionally, we view di corporate hospitality packages, including one for England v Panama wey dey $124,800 (£94,444) for luxury suite wit 24 match tickets, food and drink - $5,200 (£3,935) per pesin.
Di availability of games appear to be changing all di time, and Fifa don indicate say new tickets fit dey released for any game right up to kick-off.
By 08:00 on Thursday, 13 games still dey show, though six of dis only get wheelchair companion tickets, wey dem no fit sell to di general public.
Controversially, Fifa neva make any free tickets available to di assistants of fans wey dey use wheelchairs. Dem gatz buy tickets at full price and dem fit no siddown next to each oda.
Di USA opening game against Paraguay on 13 June get di most tickets still on sale, wit 1,406 category one tickets priced at $2,735 (£2,072).
Canada first match against Bosnia-Herzegovina na di only oda match wit relatively good supply - 846 category one tickets still dey on sale at cost of $2,240 (£1,697).
Fifa resale platform, wey dey likely to bring even higher prices wit both buyer and seller charged 15% fee, go reopen on Thursday.
- Wetin Inec decision to derecognise ADC wey David Mark dey lead mean for di party
- Fresh violence for Jos Plateau State afta Angwan Rukuba attack wey kill more dan 20 pipo
- Key takeaways from Trump primetime speech on Iran war as Tehran cut warning give US











