You are here: HomeAfrica2021 05 20Article 1266058

Africa News of Thursday, 20 May 2021

Source: www.bbc.com

Shekau death: Five times wen Boko Haram leader Abubakar Shekau don 'die'

Boko Haram leader Abubakar Shekau fit don die Boko Haram leader Abubakar Shekau fit don die

Authorities for Nigeria never confam tori wey dey trend for social media say Boko Haram leader Abubakar Shekau fit don die.

Dis no be di first time dis kain tori dey come out since Shekau begin lead di extremist group wey dey disturb North eastern Nigeria.

Questions from some sabi pipo around di mata also make pipo dey wonda wetin dey happen with Shekau.



Although di federal goment and di Nigerian army never confam dis latest tori, dis no be di first time di possible death of Shekau dey make news.

See di oda times wey e happun.

Di plenti times Shekau don die

  • Di first time dem report say Shekau don die na for 2009. Security forces launch operation against di group, kill hundreds of dem, tori be say Shekau die dat time but e later re-appear inside one video dem post ontop internet less dan a year later as Boko Haram new oga.


  • For August 2013, Nigerian army tok say dem injure Shekau bad-bad wen dem raid Boko Haram base for Sambisa forest, but one video show for September wen one man wey claim say im be Shekau say dem never kill am.


  • Anoda time tori come out say Shekau don die na for 2014. Nigerian army say im die for battle for Kodunga wey last from September 12 to 14th. Cameroonian military back di claim wen dem post foto to show say im don die. E no tey wen anoda video show wia Shekau again yeye di tori say dem don kill am.


  • For 2015, na di President of Chad Idriss Deby tok say Boko Haram own don finish say anoda leader don take ova from Shekau. Dis time na for one audio message Shekau reply say im still be di leader and e never die.


  • For 2016, di Nigerian Airforce announce say dem injure Shekau bad-bad, kill some oda leaders during airstrike for Taye village on August 19 2016, dis time na ontop you tube video appear wey show Shekau alive.


For 2016, tori be say Boko Haram break into two factions.

Di group wey break comot pledge to Islamic State come later become di Islamic State for West African Province.

Boko Haram don dey terrorise North-Eastern Nigeria for over 10 years, and na dem dey behind di increasing kidnappings inside di region, including di 2014 kolobi of 276 schoolgirls from Chibok town and di March 2018 kolobi of more than 100 girls from Government Girls Secondary School, Dapchi.

Inside Nigeria alone, di gbege and kill kill for north east region wey Boko Haram dey don last for 10 years (since 2009) and e don kill thousands and scata millions of pipo across dis region.

Di goment of Nigeria still dey insist say dem son punch deadly blow on Boko Haram face but di group still dey cari out attacks.

Since di early 2010s, Boko Haram militants don gada more power and influence, come even spread from Nigeria enta neighbouring Cameroon, Chad and Niger.