Africa News of Monday, 3 May 2021
Source: www.bbc.com
Di Akwa Ibom State Police Command don arrest 20 year old Uduak Frank Akpan for di suspected kidnap, rape and murder of Miss Iniobong Umoren.
For Statement wey di Police tok tok pesin Odiko Macdon sign say men of di Anti-Kidnapping Squad of di Command from dia investigation arrest di suspect, Uduak Frank Akpan and im confess how im lure di victim, Miss Umoren to im house say im wan give her job but come sexually and physically assault her till she die.
To hide wetin im do, im drag and bury her for im papa compound but di police don exhume di deadibody and put am for University of Uyo Teaching Hospital UUTH for autopsy.
Developing story:
— Ufan Akwa Ibom #EndSars (@Itycletylove) May 2, 2021
Bring our sisters corpse, we want to see her - family members of Ini Umoren cries out
... Says the Nigerian Police Force must not play hide and seek game with their sister's corpse#FindHinnyHumoren pic.twitter.com/YQRRZAcTC4