You are here: HomeSports2013 02 24Article 265829

Sports Features of Sunday, 24 February 2013

Source: Temisan Okomi

Ghana deny Ashawo visitors

Amebo pipu for Ghana bin don dey carri tori say na ashewo make Ghana no fit win Nations Cup for South Africa, but dia futbal pipu say 'na lie!'

"Ghana futbal village meeting (GFA) don dey hear one kin tori say ashewo bin enta Black Stars (na Ghana guyname) camp wen we bin dey South Africa," na so de futbal pipu start dia yarn.

De futbal pipu come tok say de whole tori na "beta lie" becos dem bin "carri beta ekelebe (na so we dey call 'police' for we area) to dey put eye for all de playa dem and de team oga dem sef."

Dem yarn say "de FA belle sweet wit de police (una for ask wetin 'ekelebe' be again) wey bin follow de team, and de one wey South Africa sef give us."

De FA pipu tok say "de team get how dem suppose dey behave and if any playa bin do anyhow, we for show de persin pepper."

Dem tok say "all our playa bin too behave demsef and nobodi bin carri anybodi enta camp wen we dey South Africa."

Dem finish dia yarn say "Black Stars dey carri Ghana flag wen dem comot and we for de futbal village meeting dey put eye for dia bodi well, well to make sure say na so e be."