You are here: HomeAfricaBBC2024 05 09Article 1930200

BBC Pidgin of Thursday, 9 May 2024

Source: BBC

Social media react to video wey suggest say Justin Bieber and wife Hailey dey expect dia first child

Justin Bieber and wife Hailey Justin Bieber and wife Hailey

Ogbonge Canadian singer Justin Bieber and im Super Model wife Hailey dey expect dia first child togeda.

Justin Bieber share one video for im Instagram page on May 9 wey show im wife Hailey Bieber dey hold her baby bump.

But Justin Bieber no tok anything to explain di video.

Although im no tok anything, pipo don flood dia social media pages to congratulate di couple.

As at di time we publish dis tori, di post don already get over three million likes and over 200 comments for Justin Bieber Instagram page just one hour wen e post di video.

Na for 2018 reports show say di den 21-year-old model and di pop superstar bin marry secretly for September.

She and Justin, wey be 24 at di time, bin announce dia engagement for July dat year. Justin write for Instagram say: "Hailey I dey soooo in love with everything about you!

"So committed to spending my life getting to know every single part of you loving you patiently and kindly.

"My heart dey COMPLETELY and FULLY YOURS and I go ALWAYS put you first!

"You be di love of my life Hailey Baldwin and I no go wan spend am with anybody else."