You are here: HomeAfricaBBC2024 05 17Article 1931319

BBC Pidgin of Friday, 17 May 2024

Source: BBC

Fans, family pay last respect to Nollywood actor Junior Pope

The late Nollywood actor Obumneme Odonwodo aka Junior Pope The late Nollywood actor Obumneme Odonwodo aka Junior Pope

Di burial ceremony of late ogbonge Nollywood actor Obumneme Odonwodo aka Junior Pope do dey go on for Enugu state.

For April 2024, report spread say Junior Pope bin drown afta boat wey im and some movie crew members dey inside bin capsize for River Niger on 10 April 2024.

Unfortunately, President of di Actors Guild of Nigeria (AGN) Emeka Rollas Ejezie confam di death of Junior Pope, for im Facebook account on Wednesday 11 April.

Di burial arrangement start on Monday 13 May 2024, wia dem do Mass for am for di Christ the King Parish for Enugu state.

On Tuesday 14 May 2024, dem organise Evening of Tributes and Candle Light for late Junior Pope.

Na on Thursday dem do wake keep for di body for im home town- Uwala Abaka, Ukehe, in Nsuka .

Di body of Junior Pope go enta ground on Friday afta dem do all do funeral rites.

For April, Junior Pope dey go for one movie shoot wey am take boat wit oda crew but e no end well.

Di boat capsize and about ova 3 pipo bin die.

Who be Junior Pope

Junior Pope come from Ukehe, Enugu State, and im be di sixth among eight pikin wey im parent born and dem born am for Bamenda, Cameroon.

Im papa be trader and im mama comot for Nigeria go Cameroon during di civil war.

Junior Pope attend primary and secondary school education for Cameroon, e later come back to Nigeria for university education for University of Nigeria Nsukka.

Di Nollywood actor graduate wit degree in Accounting but start to dey act feem Nollywood movies for 2006.

For 2007, e become famous afta im role for “Secret Adventures” wey Tchidi Chikere be di feem director.

E don act for ova 100 Nollywood feems such as: “Secret Adventures”, “Vengeance of Bullet”, “Di Cat”, “Mad sex”, “Bitter Generation”, “Di Generals”, “Wrong Initiation” among odas.

For 2010, im win im first award as di Most Promising Nollywood Actor from Entertainment Factory Awards.