You are here: HomeAfricaBBC2024 05 12Article 1930436

BBC Pidgin of Sunday, 12 May 2024

Source: BBC

How you fit keep your child safe online - Tips on wetin parents fit do

A file photo of a mother and her child A file photo of a mother and her child

Parents dey always tink say dia children dey safe anytime wey dem dey browse online sake of say di child dey quiet.

If only dem sabi wetin dia pikin dey do and wetin dem dey watch as dem dey browse through different social media platforms.

Many children don dey use phone for dia little age and dem even dey all di social media platforms without dia parents monitoring dem.

Children wey dey below 18 years dey access social media platforms and some parents no dey take note of wetin dem dey exposed to.

Some of di social media platforms include: Whatsapp, Facebook, Youtube, X, Snapchat, Instagram, Tiktok and many odas.

Some dangerous contents wey children dey watch online:

- Child sexual abuse
- Wicked behaviour - contents wey dem no regard human dignity
- Extreme sexual violence - contents wia pipo dey commit sexual assaults
- Pornography and nudity
- Contents wey dey promote suicide and self-harm
- Animal wickedness - plenti videos dey online wia pipo dey maltreat and kill animals
- Contents wia dem dey sell illegal drugs
- Contents wia dem dey sell and teach use of (dangerous) weapons
- Contents wey dey related to terrorism, banditry and violence

If parents and technology companies no take serious actions to keep children safe online, serious gbege wey dem no fit handle fit happun sake of di bad tins wey dem go dey learn.

How parent fit monitor and keep dia children safe online

Na nearly every child wey don old pass 13 years and even some wey dey below get mobile phone wia dem dey watch videos online.

Some of dem even dey share and post dia own contents too.

Many children dey chop online bully, some dey receive threats and some dey even dey involved in blackmail.

E really dey safe make parents no monitor dia pikin online?

Interestingly, many parents get to give dia children phones becos say dem go wan contact dem or track dia movement wen dem no dey dia side.

But how parents fit keep dia children safe online?

- Wen you suppose give your pikin im first cell fone and how you fit make sure say dem use am safely?
- Hope don dey for quick detection of prostate cancer for men body
- E dey possible to dislike your new-born pikin? - Doctors share wetin fit cause am

Use parental controls – but no rely on dem

One of di ways to keep your pikin safe online na to use di ‘parental control’.

Dis dey possible sake of how many devices and mobile phones come wit software wia you fit do parental settings for your pikin phone.

You fit use di settings filter di kain conetent wey your pikin go dey exposed to to keep dem safe.

Di feature dey useful and effective as e come wit customised privacy settings wey fit allow you report and block some kain contents for small pikin.

You go need to dey update your apps so di browsers go still dey up to date.

Teach dem online safety

E dey important to say, if your pikin dey online - at any age and no mata di kain device wey e dey use – make you tok to dem about online safety.

Parents get role to play in educating dia children and raising awareness about di risks of using internet, while teaching dem say most online experiences no dey dangerous.

Wetin young pipo dey tok most times be say dem wan know wia to turn to wen dem need help.

Dem wan dey sure say dem go receive support, not warning or seizing dia phone.

Dis mean say, di important first step na to reassure your pikin say dem fit tell you about any problem wey dem dey get and dem go get help without judgment.

E also dey important to tok to your pikin about wetin dem fit or no fit do wit di device.

Dis fit include, for example, setting ground rules about which apps to install and wen to stop using dem.

You need to also review di privacy settings of apps wey your pikin dey use, to make sure say dem no fit contact strangers or access contents wey no proper.

- Wen you suppose give your pikin im first cell fone and how you fit make sure say dem use am safely?
- Pipo fit begin do face scan before dem watch blue feem for UK
- How 90 children land hospital afta dem chop cookies wey dem mix wit igbo