You are here: HomeAfricaBBC2024 05 21Article 1931946

BBC Pidgin of Tuesday, 21 May 2024

Source: BBC

How pesin die, odas injure inside flight wey enta turbulence and suddenly drop for air

Na 229 pipo dey inside di flight wen e suddenly drop for air Na 229 pipo dey inside di flight wen e suddenly drop for air

One pesin don die and more dan 30 more pipo bin injure inside di Singapore Airlines flight wey comot London.

Di Singapore-bound Boeing 777-300ER bin divert go Bangkok and make an emergency landing at 15:45 local time (08:00 GMT).

One British man wey be 73-years-old bin die for di flight.

Wetin cause di wahala be say di flight dey hit by serious turbulence (movement wey dey make di flight dey unstable on-air).

Di flight bin dey carry a total of 211 passengers and 18 crew (making 229 onboard).

According to passengers wey dey inside di flight, di aircraft bin suddenly drop wey make objects wey dey inside dey fall from di cabin.

Singapore Airlines "offer dia deepest condolences to di family of di deceased," for one statement wey dem release.

Di airline add say dem dey work wit Thai authorities to provide medical assistance to passengers, and dem don send team to Bangkok to provide any additional assistance wey dem go need.

Thai authorities don send ambulances and emergency teams to di Suvarnabhumi Airport.

Singapore Transport Minister Chee Hong Tat say di goment go provide assistance to di passengers and dia families.

"I dey deeply saddened to learn about di incident onboard Singapore Airlines flight SQ321 from London Heathrow to Singapore," e tok for one statement on Facebook.

E still dey unclear on wetin happun on board di flight.

Turbulence fit dey serious sake of say sometimes e fit dey predicted - and pilots dey radio each oda to give advance warnings.

But sadly, turbulence fit also come out of nowhere. Even though na weather phenomenon, turbulence fit happun anywia and in any condition.

How e happun

One passenger tell Reuters news agency say di aircraft bin suddenly start "dey go up and begin to shake".

Im add say di flight just drop from di air and pipo wey no wear dia seatbelt dey affected as dem begin fall and dem dey thrown into di air.

"So I begin dey ready for wetin dey happun, and very suddenly, a very dramatic drop happun so everyone wey dey dia seat but no wear seatbelt dey thrown immediately into di ceiling," 28-year-old student Dzafran Azmir tok.

"Some pipo hit dia heads for di baggage cabin overhead, dem hit di places wia lights and masks dey and e break straight through am."


'31 pipo dey hospital'

Di airline say 31 pipo wey also dey inside di flight don already dey hospital sake of di effect of di turbulence.

"Di remaining passengers and crew dey under examination and go also receive treatment wia necessary for Suvarnabhumi International Airport inside Bangkok."

Di authority say one 73-year-old British national wey die inside di aircraft fit be sake of heart attack.

Seven pipo currently dey for critical condition sake of di severe turbulence.

Tori be say about 53 passengers currently dey hurt as more operations still dey go on to check on di remaining pipo.

'Di plane drop and pipo begin dey scream', passenger tell BBC

One passenger wey dey inside di Singapore Airlines flight tell BBC say di aircraft bin “suddenly drop” as objects dey fly around di cabin sake of di turbulence.

“I dey covered in coffee,” Andrew Davies from London tell BBC.

“During di few seconds wey di plane dey drop, plenty pipo scream well-well and objects dey fall for ground."

As di aircraft bin settle small, Andrew say im dey able to help one lady wey dey "scream in agony" and she get "cut ontop her head".

"One of di Singapore Airlines crew na by far di worst in her 30 years of flying," Andrew tok.

E describe as e see some passengers dey give first aid and also dey shout for defibrillator.

"So many injured pipo - head lacerations, bleeding ears," Andrew tok. "One lady bin dey scream in pain with a bad back. I no fir help her - I just give her water.

"Plenty pipo injure - including di air stewards wey bin remain calm and do everything dem fit.

"I wish I for fit help more."


Photo show inside di plane afta di turbulence. Objects bin fall to di ground as di flight drop.