You are here: HomeAfricaBBC2024 05 19Article 1931675

BBC Pidgin of Sunday, 19 May 2024

Source: BBC

Helicopter wey dey Iran president convoy crash - state media

Iranian President Ebrahim Raisi Iranian President Ebrahim Raisi

One helicopter wey dey convoy wey carry di President of Iran don get accident.

Di state media dey report say di situation wey surround di accident neva clear.

E neva also dey clear whether Iran President Ebrahim Raisi dey onboard for inside di helicopter.

Di state media add say di helicopter bin get difficulty in landing.

Meanwhile, Interior Minister say di pipo wey go rescue di helicopter still dey try reach di site wey di accident happun.

Dem add say di weather conditions still dey difficult as dem dey try search for di helicopter.

Tori be say President Raisi dey go city of Tabriz, for north west of Iran, afta e return from di border wit Azerbaijan, wia e open di Qiz Qalasi and Khodaafarin dams.

Di area wey di accident happun dey about 50km to di north of Tabriz.

Ahmad Alirezabeigi, Iranian MP for di city of Tabriz, tell tori pipo for Tehran say di rescue workers neva see di location of di helicopter wey carry di president.

E add say di oda two helicopters wey dey di convoy land safely.

Iran state TV don confam say President Ebrahim Raisi, im foreign minister and odas wey dey inside di helicopter wey crash on Sunday don die.

Foreign minister Hossein Amir-Abdollahian and several oda also dey among di dead

Wen di accident happun, Russia, Azerbaijan and Armenia - Turkey even send mountain rescue team to Iran

Early mor-mor on Monday dem identify di body of three more victims from di crash – dem be Ayatollah Mohammad Ali Al-e Hashem, di imam for Friday prayers in di city of Tabriz, and General Malek Rahmati, di govnor of the Iranian province of East Azerbaijan.

Di commander of di president protection unit, Sardar Seyed Mehdi Mousavi, also die along wit a number of bodyguards and helicopter crew wey dem neva sabi dia names.

Di state media say di helicopter bin get difficulty in landing.

Tori be say President Raisi dey go city of Tabriz, for north west of Iran, afta e return from di border wit Azerbaijan, wia e open di Qiz Qalasi and Khodaafarin dams.

Di area wey di accident happun dey about 50km to di north of Tabriz.

Ahmad Alirezabeigi, Iranian MP for di city of Tabriz, tell tori pipo for Tehran say di oda two helicopters wey dey di convoy land safely.


Who be Iranian President Ebrahim Raisi?

Oga Raisi, wey die at di age of 63 years old na former hard-line cleric wey dey close to Iran Supreme Leader Ayotallah Ali Khamenei.

Im election for 2021 consolidate di control of conservatives for evri part of di Islamic Republic.

Di former judiciary chief succeed Hassan Rouhani afta im landslide victory for election wey make dem bar plenti moderate and reformists candidates and majority of voters stay away.

Im take power as Iran dey face plenti challenges, including serious economic problems, regional tensions wey don tey, and plenty tok-tok on di revival of one nuclear deal wit world powers.

However, im time for office bin dey dominated by di anti-goment protests wey bin sweep across Iran for 2022, as well as di current war for Gaza between Israel and di Palestinian group Hamas wey Iran dey support, during dis time Iran shadow war wit Israel burst open.

Im bin don also face pressure from many Iranians and human rights activists for investigation into im alleged role for mass executions of political prisoners during di 1980s.

Dem born Ebrahim Raisi for 1960 for Mashhad, wey be di second biggest city for Iran and home to di holiest Shia Muslim shrine.

Im father, na cleric bifor and im die wen Ebrahim Raisi bin dey five years old.

Raisi, wey bin dey always wear black turban to identify am for Shia tradition as a descendant of di Prophet Muhammad, follow im father footsteps as im start to attend one seminary for di holy city of Qom wen im bin dey 15 years..

During im time as student, im bin take part for protests against di Western-backed Shah, wey dem eventually topple for1979 for one Islamic Revolution wey Ayatollah Ruhollah Khomeini bin lead.

Afta di revolution im join di judiciary and served as a prosecutor for plenti cities as im being dey also undergo training by Ayatollah Khamenei, wey become Iran president for 1981.

Links to Iran 'death committee'

Raisi become di deputy prosecutor for Tehran wen im bin dey only 25 years old.

Wen im dey for dat position im serve as one of di four judges wey dey judge secret tribunals wey dem set up for 1988 wey pipo later know di tribunal as "Death Committee".

Di tribunals "re-try" thousands of prisoners wey bin dey already serve jail sentences for dia political activities.

Most of dem na members of di leftist opposition group Mujahedin-e Khalq (MEK), wey dem also known as di People's Mujahedin Organisation of Iran (PMOI).

Di exact number of di pipo wey di tribunals bin sentence to death no dey known, but human rights groups tok say na about 5,000 men and women wey dem bin execute and bury for unmarked mass graves for wetin later become crime against humanity.

Leaders of di Islamic Republic no dey deny say executions bin happun, but dem no dey discuss details and di legality of di individual cases.

Raisi bin dey deny im role for di death sentences evritime. But im also say dem dey justified because of a fatwa, or religious ruling, by Ayatollah Khomeini.

For 2016, one audio tape of one 1988 meeting between Raisi, and several oda members of di judiciary and di Deputy Supreme Leader dat time Ayatollah Hossein Ali Montazeri (1922-2009) bin leak.

For di tape, dem hear as Montazeri dey describe di executions as "di biggest crime for di history of di Islamic Republic".

One year later Montazeri lose im position as di successor of Khomeini wey dem choose.

Ayatollah Khamenei con become di Supreme Leader wen Khomeini die.

Wen dem ask for 2021 about im alleged role for di mass executions, Raisi bin tell reporters: "If a judge, a prosecutor, don defend di security of di pipo, dem suppose praise am... I dey proud to defend human rights in evri position wey I bin don hold so far."

Unlikely presidential ambitions

In 2017, Raisi surprise observers wen im stand for presidency.

Rouhani, wey be im fellow cleric, bin win a second term wit landslide for di first round of di election, im bin get 57% of di vote.

Raisi, wey bin present imsef as an anti-corruption fighter but bin dey face accuse by di president say im bin no dey do anytin to tackle stealing as deputy judiciary chief, finish second wit 38%.

Di loss no spoil Raisi image and for 2019 Ayatollah Khamenei give am di most powerful position as di head of di judiciary.

Di following week, dem also elect am as deputy chairman of di Assembly of Experts, di 88-member clerical body dey responsible for electing di next Supreme Leader.

As judiciary chief, Raisi bin implement reforms reduce di number of pipo wey dem sentence to death and execute for drug-related offences for di kontri.

However, Iran kontinu to put more pipo to death dan any oda kontri apart from China.

Di judiciary also kontinu to work wit di security services to crack down on pipo wey get different opinion from dia own and to prosecute many Iranians wey get dual nationality or foreign permanent residency for spying charges.