You are here: HomeAfricaBBC2024 05 20Article 1931688

BBC Pidgin of Monday, 20 May 2024

Source: BBC

Accident wey involve Ghana president Akufo-Addo - wetin we know

di accident wey involve four cars happun along di Accra-Kumasi highway di accident wey involve four cars happun along di Accra-Kumasi highway

One pesin don die wey plenti odas hurt for one accident wey dey involve di convoy of Ghana president Nana Akufo-Addo.

Di deceased na one of di drivers for di convoy wey im name na Kwesi Atta.

At least three of di pipo wey hurt na military attachment to di president.

One statement from di presidency don confam say dem “evacuate di injured to di university of Ghana medical center for further treatment afta dia initial treatment for di Suhum goment hospital.”

Di statement also confam say di president no dey inside di convoy during di accident.

“Fortunately, di president dey safe wey im neva hurt sake of im travel to Accra wit military aircraft”.

Di president, im Vice and oda high-ranking goment officials don travel to Kumasi for di funeral of Ghana deputy finance minister Dr John Kumah wey die on 7 March.

Di president also attend oda events for di Ashanti region ova di weekend.

Na so di convoy don dey return to Accra wey di accident happun for Bunso-Allen Asafo along di Accra-Kumasi highway on Sunday.

One viral video dey show one of di cars wey burn into ashes.

Di statement from di presidency tok say “several vehicles among di convoy don scatter as a result of di accident”.

“Our thoughts and prayers dey wit di family of di deceased, we also wish di pipo wey hurt, speedy recovery,” tok tok pesin for presidency, Eugene Arhin don tok.

In January dis year, di convoy of di wife of di Vice President, Samira Bawumia also get accident wey one of im bodyguards don die.

Di accident involve four cars, wey im happun along di same Accra-Kumasi highway.

Di wife of di VP escape “unhurt” for dat accident.