You are here: HomeBusiness2018 09 28Article 688615

General News of Friday, 28 September 2018

Source: bbc.com/pidgin

Menzgold announce 'AU Day' give customers for Ghana after dem sue SEC den BoG

MenzGold Company will begin payments of dividends to customers on Friday play videoMenzGold Company will begin payments of dividends to customers on Friday

Friday be Aurum Utalium day for Ghana give Menzgold customers after management announce say dem go start payment of clients dema dividends.

Dis be something wey chaw customers dey look forward to as menerz dey fear say dema monies go lock for di business inside.

But according to Corporate Affairs Manager for Menzgold, Nana Yaw Ofei, dem no go fit pay customers wey dema investments dey mature after September 12, sake of di directive of SEC which shut dema gold vault market.

Menzgold Saga: Business no be thing for di Pope - NAM1 to Ghanaians Menzgold company dey make some pipo heart beat gbimgbimgbim for Ghana Meanwhile, Menzgold carry Bank of Ghana den Securities and Exchange Commission go court over claims say di two regulators dey spoil dema business.

Lawyer for di plaintiff Kwame Akuffo file di suit on behalf of Menzgold, dem dey demand say make di court restrain di two institutions from interfering in dema business.



According Menzgold, di notices BoG den SEC dey give about dema business dey cause damage to di reputation of dema business, again dema actions dey constitute abuse of dema office.