BBC Pidgin of Wednesday, 14 May 2025
Source: BBC
President Cyrill Ramaphosa don call one group of 59 white South Africans wey japa go US to resettle say dem be "cowards", say "dem go come back soon."
Di group of Afrikaners land for US on Monday afta President Donald Trump give dem refugee status, say dem dey face racial discrimination.
But Ramaphosa tok say na pipo wey no happy with di way dem dey try fix wetin apartheid cause na im dey run comot, and e call di relocation "sad moment for dem".
"As South Africans, we dey strong. We no dey run away from our problems. We need to stay and solve our own wahala. Wen you run, na coward you be, and na real "cowardly act" e add.
Trump and im padi-padi, Elon Musk wey dem born for South Africa, don tok say white farmers for South Africa dey face "genocide" but many pipo don reject dat tok say no be true.
US don also accuse South African goment say dem dey collect land from white farmers witout paying dem.
Over 30 years afta white minority rule end, black farmers still get small piece of better farmland, while most still dey under white control, dis one dey cause serious wahala as change slow.
For January, President Ramaphosa sign one controversial law wey go allow goment collect private land witout pay, as long as dem believe say "na for public good and e dey fair".
But goment still tok say dem never collect any land under dat law.
Trump don offer to carry di white Afrikaners wey be mostly Dutch pipo come US, say dem dey run from "terrible situation" for South Africa.
On Monday, Ramaphosa tok for one agriculture show for Free State province say, di Afrikaners dey move go US because dem no like how e dey try to fix di kontiri wahala.
"If you check all di groups for dis our country, black and white, dem still dey here because na our country, we no suppose run from our wahala. We need toand stay solve am," Ramaphosa tok.
"I fit bet say dem go come back because no country dey like South Africa" e add.
Im "coward" word don make some pipo vex and angry for social media, e make some social media users condemn am also see am as insult for white South Africans.
Di Afrikaner group get big welcome from top US officials wey tok say dem dey "live under violence and fear" for South Africa.
"Welcome to di land of di free," na wetin Deputy Secretary of State Chris Landau yan as e welcome dem for Dulles airport near Washington DC on Monday.
Some carry small pikins and wave small American flags, as evri wia dey decorated wit red, white, and blue balloons.
Earlier on Monday, Ramaphosa tell one Africa CEO Forum for Abidjan, Ivory Coast, say e recently tell Trump for phone say di US tok about South Africa "no true".
"We be di only country for Africa wey di colonisers come stay, and we never chase dem comot," e add, say di tok say Afrikaners dey suffer no be true.
Ramaphosa still tok say di white South Africans wey land US on Monday "no fit di bill" for refugee.
E say e go soon meet wit Trump to tok about di mata.
Trump don even threaten say e no go come G20 summit for South Africa unless dem "fix di situation".

