You are here: HomeAfricaBBC2021 04 05Article 1224043

BBC Pidgin of Monday, 5 April 2021

Source: BBC

Pope Francis ask pipo to not 'lose hope' sake of coronavirus - See oda tins e tok for Easter message

Di Catholic Pope Francis don give im ninth annual Urbi et Orbi alias Easter Message for di St Peter's Basilica.

For di Saturday Easter vigil, di Pope bin focus im message for wia Jesus go afta im bin rise, Galilee and wetin dat one mean for believers.

E admonish pipo say "for dis dark months of pandemic, make we listen to di Risen Lord as im call us to start afresh and no loose hope."

Dis go be di second year wey di pope go give im easter message for inside empty St Peter's Basilica sake of di Covid 19 Pandemic.

Already, Italy don go on National lockdown as dem dey fear say di third wave of di pandemic fit enta gear two with di Easter Celebration.

Pope Francis comot three messages from di tin wey di angel for di tomb tok, wen im say "He is risen and e dey wait you fir Galilee"

Di first one na say, go to Galilee means fresh start. For im message, Pope Francis say, "e dey possible to begin anew, because new life dey wey God fit wake from inside us even with our failures."

Di second one be say, going to Galilee mean say make you open your heart to know God wey fit surprise you. E say "faith no be album of past memories on top say Jesus no be old school."

Di third message be say, Jesus love 'us' even in di middle of di kasala wey dey burst everyday. E mention say, even as di old Galilee bin dey outside of Jerusalem wey pipo dey see dat time as holy and bin dey very poor and wretched, Jesus still go dia.

Pope Francis say "make we see am for our Galilees, for every day life and with am, life go change."