BBC Pidgin of Friday, 30 April 2021
Source: BBC
Residents for Lagos State, Nigeria commercial capital go now get chance to watch television channels through digital broadcasting.
Di Nigeria Minister of Information and Culture Lai Mohammed, plus oda goment officials, officially launch di Lagos switchover of television broadcasting from analogue to digital, on Thursday, 29 April.
Although na for Jos, Plateau State di federal goment bin first launch di new free-to-air service, as di roll-out dey happen one phase after anoda.
Di federal goment regulatory joinbodi National Broadcasting Commission (NBC), during di Lagos launch say six months from 29 April, residents for di state no go fit watch analogue television stations again as dem go switch am off.
One afta anoda, di Nigeria goment officials wey talk say dis new digital television service go free Nigerians from di burden of big money wey commercial Pay TV companies dey collect.
5 key tins to know about Nigeria 'Free TV' digital service