Virginia Giuffre, one of Jeffrey Epstein most prominent accusers, say she dey hospital after one serious accident.
Ms Giuffre post for Instagram say she suffer kidney failure after her car collide with one school bus, she say her doctors don give her "four days to live" and dem dey transfer her to a specialist hospital.
Inside statement she share with BBC, her spokesperson Dini von Mueffling say: "Virginia dey for serious accident and dey receive medical care for hospital. She greatly appreciate di support and well wishes pipo dey send."
Ms Giuffre say dis year na "di worst", she post photograph from one hospital bed wey show her wit bruises.
Di 41-year-old describe di accident inside Instagram post, writing say di crash dey so serious say her car "be like a tin can".
"I dey ready to go, just not until I see my babies one last time," she add, as she refer to her three children.
Ms Giuffre bin recently dey live wit her children and husband Robert for di suburb of North Perth, Australia, though recent reports suggest say di couple don separate after 22 years of marriage.
E no clear where and when di crash happen.
Both di Western Australia police and ambulance service tell BBC say no records of such an accident wey happen in recent weeks.
Police later specify say dem don locate records of one "minor crash" between a bus and a car on 24 March, but say no injuries bin dey reported as a result.
Ms Giuffre dey best known for her allegations say Epstein and Ghislaine Maxwell traffic her to di Duke of York when she be 17.
Prince Andrew don deny all claims but reach one out-of-court settlement with her for 2022.
Di settlement include statement where e express regret for im association with Epstein but e no contain any admission of liability or apology.
Who be Virginia Giuffre
Dem born Ms Giuffre as Virginia Roberts for 1983 for di US state of California. Her family later relocate to Florida.
At di age of seven, she say family friend sexually abuse am, and her "childhood bin dey quickly taken away".
She tell BBC Panorama for 2019 say she run comot for house at a young age.
Later for her childhood, she bin dey in and out of foster care. And by di age of 14, she dey live on di streets where she say she found nothing "except for hunger and pain and [more] abuse".
She say na for 2000 she meet British socialite Ghislaine Maxwell.
Ms Giuffre bin dey work as a locker room attendant for Donald Trump Mar-a-Lago resort for Palm Beach, and say Maxwell offer her interview for di chance to train as massage therapist.
Ms Giuffre say wen she arrive for Epstein home for Palm Beach, e bin lie down naked and Maxwell instruct am on how to massage am.
Ms Giuffre say wetin she expect to be a job interview soon turn into di beginning of years of abuse.
For 2015, Ms Giuffre file defamation case against Maxwell after she accuse her of being a liar. Dem don since settle di case.
Ms Giuffre say she go from being abused by Epstein to being "passed around like a platter of fruit" among im powerful associates, as dem take her around di world on private jets.
For 2001, at di age of 17, she say Epstein bring her to London and introduce her to Prince Andrew. One now famous photograph wey she say dem take on dat night show di prince wit im arm around Ms Giuffre, as Maxwell dey smile for di background.
"Na a really scary time in my life…Dem no chain me to a sink, but dis powerful pipo be my chains," she tell BBC.
For her civil case, Ms Giuffre allege say di prince sexually abuse her three times - for Maxwell London home dat night, and later for Epstein homes for Manhattan and Little St James for di Virgin Islands.
Prince Andrew tok for interview with BBC Newsnight for 2019 say e no remember ever meeting Ms Giuffre, and, in response to her account of dem having sex for US and UK, e say e no "happen".
Ms Giuffre tell di Miami Herald sat by 2003 Epstein bin don lose interest in her becos too old for am.
She say she convince di wealthy financier to pay for her to get training to become a real professional masseuse and e arrange for her to take di class for Thailand. But she bin also dey expected to bring home one Thai girl wey Epstein bin arrange to come US.
Instead, Ms Giuffre meet one man on di trip wey she fall in love with and marry 10 days later. She move wit am to Australia to start a family.
She found a non-profit organisation called Speak Out, Act, Reclaim (SOAR), wey di goal na "educating and advocating for victims of trafficking".
Additional reporting by Tiffanie Turnbull, BBC News, Sydney











