You are here: HomeAfricaBBC2021 04 03Article 1223458

BBC Pidgin of Saturday, 3 April 2021

Source: BBC

Don Jazzy wife: Nigerian producer 'reveal' im marriage of 18 years ago to Michelle Jackson

Nigerians dey react to ogbonge music producer Don Jazzy 'big' revelation say e bin marry almost 18 years ago at di age of 20.

Inside Instagram post e make on Saturday, di ogbonge producer reveal say di marriage end for divorce wen e be 22 years because of im love for music wey no make am give im best for di marriage.

"For so long everyone keep on asking me wen I go marry? Well truth na say almost 18 years ago I was 20 and I marry to my best friend Michelle @yarnstaswitch and e dey beautiful.

"I loved love and I loved marriage. Michelle is soooo beautiful inside and outside with such a soft heart. But den sake of say I be dey so young and full of dreams I went and f***** it up cos I bin dey give all my time to my Music," Don Jazzy tok.



View this post on Instagram

A post shared by ITS DON JAZZY AGAIN