You are here: HomeAfricaBBC2021 05 03Article 1249501

BBC Pidgin of Monday, 3 May 2021

Source: BBC

DSS: Nigeria spy agency warn group with 'agenda' to cause katakata for di kontri

File foto of DSS operatives File foto of DSS operatives

Di Department of State Services (DSS) say dem no go longer tolerate any agenda by some group pf pipo to cauase katakata for di kontri.

DSS tok dis one on Sunday as dem condemn wetin dem say na some kain statements by misguided elements wey don continue to dey threaten goment, sovereignty, and corporate existence of di kontri.

"Di one wey dey of note na di unnecessary tok and activities of some religious and past political leaders wey don either call for a forceful change of goment or mass action against it. E don dey established say di main objective of dis na to cause di kontri to scata.

E dey unfortunate say those wey dey lead di call na respectable individuals wey suppose dey patriotic and not allow dia personal ambitions to spoil di nation." DSS tok.

Di Service say dem also note di group dem dia desperation to collaborate with external forces and influence against Nigeria.

"Dem dey reminded say even though democracy offer free speech, e no give room to reckless pronouncements wey fit affect security.

"In dis regard, self-centred individuals and groups dey warned to stop to dey engage in acts wey fit spoil di peace and sovereignty of di nation.

Influential personalities should dey sensitive to dis kain situations and guard against comments wey fit cause division wey fit cause breakdown of law and order." Di statement add.

DSS say dem dey work with oda security and law enforcement agencies to ensure say dme maintain peace and internal security of di kontri.

Recently, di Service say dem invite and warn some persons wey explain dia earlier statements or say pipo pipo bin quote dem out of context.

Dis warning from DSS dey come as di kontri dey battle insecurity palava, with kidnappinp as well as attack against security personality on di rise for di nation.