You are here: HomeAfricaBBC2021 03 21Article 1211005

BBC Pidgin of Sunday, 21 March 2021

Source: BBC

As pipo dey vote today, Congo-Brazzaville presidential candidate dey hospital with Covid-19

Guy Brice Parfait Kolelas Guy Brice Parfait Kolelas

Di leading opposition candidate for Congo-Brazzaville presidential election dey hospital with Covid-19 while voting dey go on.

For inside one video wey dey trend for social media, e show how 61-year-old Guy Brice Parfait Kolelas briefly remove im oxygen mask to tell im supporters say e dey "fight death".

E tell dem to vote for di election.

Mr Kolelas, wey dey diabetic, na one of six candidates wey dey run against President Denis Sassou Nguesso.

Family members say dem dey try arrange for dem to evacuate am to France for treatment.