You are here: HomeAfricaBBC2021 03 30Article 1219498

BBC Pidgin of Tuesday, 30 March 2021

Source: BBC

Four takeaways from APC leader Tinubu popular visit to Kano

Asiwaju Bola Ahmed Tinubu, former govnor of Lagos state Asiwaju Bola Ahmed Tinubu, former govnor of Lagos state

Asiwaju Bola Ahmed Tinubu, former govnor of Lagos state for western Nigeria and big oga for di kontri ruling APC political party enter Kano for northern Nigeria to celebrate im 69th birthday.

E get di way different pipo dey use eye see di visit, some say na political ahead of di 2023 elections while some say na move to unite Nigerians after north/soutj tensions of the last couple of months.

Here na four takeaways from Tinubu popular Kano visit:

Local kata kata between PDP and APC

Among di things wey Tinubu visit cause for Kano na kata kata between ruling APC for di state and opposition PDP for di state wey former govnor Rabiu Kwankwaso belong to.

Tinubu use im visit to go see Kwankwaso for im house and dat one sit well with some pipo for APC wey say na di former govnor beg am to come as e dey eye come back to APC.

While Kwankwaso camp tok say dia oga dey very relevant politically na why Tinubu go see am.

Na di mata some pipo dey still try settle as both camps still dey prove say di visit na about dem.

Weather no allow close allies attend

Anoda major thing na how bad Kano weather' no allow some of Tinubu's closest pipo to attend di birthday celebrations.

According to Senator Babafemi Ojudu, vice president Yemi Osinbajo, house speaker Femi Gbajabiamila, Lagos govnor Babajide Sanwo Olu all no fit attend because dem hear say Kano weather dey bad.

Las Las na technology come to di rescue as all di aforementioned use video to send im dia birthday wishes to di APC leader.

Ganduje fighting corruption comment

Some of di things wey Tinubu do while in Kano na to launch some projects wey govnor Abdullahi Ganduje do, among dem na di new office for di state anti corruption board.

During di launching, Tinubu yan say e like di way Ganduje dey try wella to fight corruption for di state.

Dat comment bring alot of discussion on social media about fighting corruption and what what is needed to fight am.

50 million youth as soldiers comment

For many di most popular from the visit and celebration na when di celebrant Tinubu tok say make Federal goment recruit 50 million Nigerian youths into Army.

E tok about lack of jobs for di kontri and how criminal elements dey take advantage of dat to recruit young pipo into dia networks.

Di Jagaban comment lead to plenti discussion for social media as some pipo say 50 million youth for Army too plenti.