You are here: HomeNews2012 01 12Article 227369

Opinions of Thursday, 12 January 2012

Columnist: www.supersport.com

Ghana Must Go!

by Emeka Enyadike 10/11/ 2011, 15:58



My people talk say we big pass Ghana,

nobody dey drag! We say we get money

pass dem, dat wan na true. We even say

story story, say na we been dey give

dem work, dat wan dey too.



Me sef, na Ghana people follow teach

me for skool. One thing wey Ghana

people no go gree with us na about who

sabi play ball pass and now wey we dey

carry last, dem don dey Kampe.



Dis wan wey Africa cup of Nation don

reach so, na siddon look we go dey look

yet some people go still dey talk say “

Ghana must go”



Before we win de cup for 1980 wey

Shagari come dash de green Eagles

moto and house, Ghana been don win

am 3 times, but as we dey jollification

say we don win,na him dem come win

am back wen we go Libya for 1982, dat

time sef na Gadhafi pay dere transport

After dat time, e come be like say naija

come get power pass dem as we come

dey win u-17 world cup like pure

water.dem too come dey pursue us.

Ghana come win Bronze medal for

olumpics, we sef vex win Gold de next

time.



Naija come even win Africa cup of

nations for Tunisia, even first Ghana

reach world cup 3 times, 2 times, naija

reach second round. All de naija players

just brekete for obodo oyibo, for jand,

for Paris, for Itali. E be like say Ghana

dey carry kpondo that time. Dem come

begin plan, dem come begin to organize,

and dem come begin to find better

player and better Oyinbo coach.



See now, like play like play, Ghana don

become Ogbonge team and we dey

wonder how e happen? We go dey

wonder! We just dey look like Lukman.

Na him we say make we go play dem

friendly match for London. Ghana no

hold joke oh, nothing friendly about that

match, dem knack us 4 kpondo. Na

Ghana wey don komot naija for de lats

two Africa cup of nations .Dem win us

wen dem be landlord for Ghana 2008,

come win us again for Angola 2010 wen

dem even play with dem small boys.

Chei!



Next year wey be for Gabon and

Equatorial Guinea, na Ghana wey

everybody dey look becos of de way

wey dem dey play and dem no dey fear

anybody again. Make we no dey talk say

“Ghana must go” again oh!



Ghana don come back and dem done

balance. Dem dey Kampe! No shaking!

Nothing do dem.



See de kain money wey dem dey pay

for dere players for Obodo oyibo.Now

sef,see those Alhaji dem for Dubai don

come pay Assamoah Gyan money yanfu

yanfu sake of say make him for come

dance for dem.



Naija ! Make we wake up for

sleep.Ghana don leave us .everytime we

go dey say “Ghana must go.”

Maybe e go good if We fit go look wetin

Ghana dey do well well and see wetin

dem fit teach us.wetin wey we fit

photocopy.



Shame no dey inside oh! Shame no dey

inside, afterall dem be our brodas and

our neigbours. Na we don dey teach

dem business and so many other things

but if na ball.



Like play,like play,dem even win the Fifa

Junior world cup wey dem been call

Egypt 2009.



Ghana don standby. Ghana don

overtake us.even if we still dey talk say

“Ghana must go”



When Ghana first reach worldi cup for

Germany 2006, naija no show! Dem don

sabi play sotaydem show us say no be

who first call police dey win case. Dem

reach world cup,dem reach second

round. When we dey carry kpondo for

South Africa 2010,Ghana nearly reach

semi-finals.



Una say,we no go there go find out

wetin dem dey do.If not oh Luiz suarez

for Uruguay wey turn second Goal

keeper, na wetin we for dey talk?

Maybe dem for kuku win de world cup!

So I dey ask una, my people , wetin wey

Ghana dey do ,wey we no fit do.No be

say dem tall pass us or maybe say dem

run pass us.



How come wey dem dey fit change

coach but dem still dey win. We own na

to change coach like wrappa sotay

now , we no fit reach nations cup.

De wan wey tire me na say only Abedi

Pele don supply three children to dem

team.Wey our players dem children.Abi

no wan sabi play ball.Haba!



As we dey always talk say “Ghana must

go.” Ghana don go, leave us for loco.

Ghana don dey go for de cup. Ghana ,

make una carry go